Chapter 19: Family in Crisis
Everywhere she go, na my name she dey call. Her friends dey add more insult, some dey post my wife picture, dey curse my family.
She even carry wahala reach my pikin school, dey shout say my pikin papa na criminal.
Na principal call me, say make I come withdraw my pikin before people carry mob reach the school. My wife faint that day. I no fit hold my tears.
God!
I cry inside house, slap wall, my knuckle dey bleed. I dey beg God for help. My mama dey pray, dey fast for me.
No be your pikin safety be the best thing?
My wife ask me every night, "Why she no thank God say her pikin dey safe? Wetin be all this?"
Why e be like say person must molest your pikin?
I dey ask God, "Wetin I do? Why this woman want make I suffer by force?"
If anybody ask her, she go start dey cry, accuse me again.
She dey repeat same story, dey point my name, dey shed crocodile tears. People believe her, dey curse me again.